CONVERSATION BTW EBOLA AND AIDS

CONVERSATION BTW EBOLA AND AIDS

AIDS: Bros na wah for you oo, u just come everybody they fear you like death, wia u get ur own from.

EBOLA: Ha ha ha, I been tell u that tym naa, say make u wait ,make u neva commot, u no gree, u rush come out, e no tey doctors tidy u...bt see me now, the patient dog, eats the fatest bone.

AIDS: na wahoo, everybody dey fear oo, no body dey near person wey u catch oo, but me, if i catch someone, no one go send, people go dey even chop wit am, hug am, even 'sleep' with am sef, without issue.

EBOLA: Bros i ready come, u know native doctor wey do ds juju for me? I dey pursue somebody sef even if im don die...u no fit carry person wey I kill from state to state like dat oo.

AIDS: Even hospital sef dey fear u oo, if dem carry ur victim come hospital, d hospital don close be that, bt me, everybody go dey go normally like say i no dey dia sef.

Ebola: Bros, no be me do u oooooo, na only u waka come naaa.

AIDS: ur case tire me ooo, I wan be like u oo, u just make me look like kindergarten. Even me dey fear u cos u fit catch me sef........
but know sey, all these Ebola u are sharing, remember that 'dia is God oooooo'.
Share on Google Plus

About News Digest

    Blogger Comment
    Facebook Comment

0 comments:

Post a Comment

Today's View